Friday, October 28, 2011

Politrikshan-tif wear Agbada

Agbada get plenti poket
For bak, poket dey
For front, poket dey
For side, poket dey
For imside, poket dey
For ouside, poket dey
For imside imside, poket dey
Na so so poket dey everiwia

Why Agbada get plenti poket
Wetin dem dey put imside dis plenti poket
Wetin dem go pak imside dis plenty poket
Na moto dem go pak put?
Na house dem go pak put?
Na rice dem wan put?
Na fufu abi n’amala dem go pak put?
Why agbada go get many many poket?

Na to tif
Das is why Agada get plenty poket
Agbada na to tif o!
Awa politrickshans dey wear Agbada
For Abuja dem wear Agabda
For Porta dem wear Agbad
For Sokoto, na Agbada
For Lagos dem take am wrapu bodi
For all ova di contiri dem wear Agbada

Dis vagabonds in power dey wear Agada
Big big tif wear Agbada
All dem politrikshans wear Agbada
All dem politirikshans kulotu na Agbada
As all of dem kulotu get plenti poket
Buba o, Sokoto o, Wrapper o, Head tie o, Cap o, even dem Panti tu.
All of dem get plenti poket,
Wi must to commot bi force dis dem plenti plenti poket
Na dis plenti poket na im dey take carrri awa moni go oooooooooooooo!

Friday, October 21, 2011

Wey dem Magikshans dey?

Dat time wi dey small
for Yaba wi si dem
for Ojulegba dem dey
for CMS dey perform
Dis magikshans dem dey everiwia
Dem dey perform
Dem dey do magik
Pik-poket dey waka wit dem
Dem con dey pik wi poket
Dem sell wi powda
Sey na lof juju
Wi rub am for face,
But di babi still slap wi gbam fo face
Dem sell wi esaminasion ring,
Wi cari firsti from bak





Dis magikshans wey dem now?
Dis wayorist wey dem dey now?
Dis magikshans wey dem now?
Dis wayorist wey dem dey now?




Di time wi don grow
Wi no si dem magikshan again
Wi waka everiwia
Wi no si dem eniwia




Dis magikshans wey dem now?
Dis wayorist wey dem dey now?




Wi con waka go temple
Na imside temple dem con dey perform dem magik
Everiwia wi put wi eye no magik again for open place
Na imside temple di magik dey


Na imside temple di magik dey


Dem con sey den no bi magikshans
People con dey folo dem collect wi moni, dem dey pik wi poket
Dem con dey call dem sefs:
Pasito, ............ but wi sey dem bi magikshans
Alufa, ............but wi sey dem bi magikshans
Apostulu, ............ but wi sey dem bi magikshans
Imamu, ............ but wi sey dem bi magikshans
Bishopu, ............ but wi sey dem bi magikshans
Mallamu, ............but wi sey dem bi magikshans
Efangelis, ............ but wi sey dem bi magikshans
Alagba, ............but wi sey dem bi magikshans
Hen, hen, hen hen, . .....Abah...... I dey laf,
Dem con dey bare di name, mi people make una wait O.....
General Overseer, an dem no dey si enitin
But.... but wi sey dem bi magikshans
Dem bi magiksans


Eledumare mo gbe O!
Eyan dudu sori r’enu!